Connect with us

As e dey Go

Transfer News: Ronaldo don warn United to begin sign players or…., Chelsea wan sign £103m De Ligt

Published

on

“Fake news!”- Cristiano Ronaldo don deny say him plan to join Sporting on loan

For transfer news today, we don dey hear now say Manchester United last season top scorer, Cristiano Ronaldo don dey warn the club say dem better begin sign players like other serious clubs or him go jus vex go find more serious club to join.

According to the matter, Ronaldo don talk to United coachie, oga Erik Ten Hag and him ready to help the coachie achieve him high pressing football. The only problem be say, United no believe say the players wey dey the club now go fit make the thing work. So therefore him want make the club sign new and improved players wey ready to run things anyhow e wan be, to return Manchester United to the top wey dem belong.

But as e be now , e be like say the club no ready to sign players because the kind behaviour wey dem dey show for transfer market so, na alakoba and bambiala behaviour. When top clubs like City, Liverpool, Tottenham and even Arsenal don enter market dey make purchases, United still dey there dey fufu. Na all diswan don make Ronaldo tell some of him paddy dem say if United continue with dis unseriousness, walai talai him go carry all him kaya including all him world best award waka leave the club.

Chelsea wan sign £103m De Ligt from Juventus

Chelsea don dey plan to do igbankwu on top the head of Juventus defender, Matthijs De Ligt as dem don begin ask about the guy. The only problem be say, the bobo marriage with Juventus suppose expire by 2024 and inside the contract, the release clause na 103 million pounds. But Juventus don tell dem make dem no worry, if dem truly need the guy and promise to treat am better than dem treat Lukaku, then we will see what we can do to help una reduce the bride price.

Transfer News: Ronaldo don warn United to begin sign players or…., Chelsea wan sign £103m De Ligt,

De Ligt get 103 million pounds release clause for him contract

De Ligt join Juventus for 2019 as one of the hottest young players inside Europe da year. The bobo carry Ajax enter UCL semi final as dem youngest ever captain after e carry dem win both Dutch League and cup. But him never really shine laidat since him join Juve and him sef fit don dey reason to leave the club. Chelsea lost both Rudiger and Christensen and dem really need experienced central defenders. De Ligt wey dey just 22 years old go be good long term option.

Barcelona dey price Lewandowski £30m

We don dey hear now say Barcelona don make new bid of 30 million pounds to take sign Robert Lewandowski from Bayern Munich. We also hear say Bayern Munich go reject the offer because na Lewandowski dem wan sell not crayfish and maggi wey go make Barcelona dey price the guy like discount.

Transfer News: Ronaldo don warn United to begin sign players or…., Chelsea wan sign £103m De Ligt,

Na Robert Lewandowski win FIFA best for 2021

Robert Lewandowski dey vex for Bayern Munich and him don yan immediately season end say na only miracle go make am play for Bayern Munich ever again. But Bayern oga dem say all dawan na story for the gods because him marriage contract remain 1 year and him must complete am whether him like or not. In fact dem don nak am ultimatum deadline say him must return to the club for preseason by July 12 or… Lewandowski na one of the hottest strikers for world today and na him win FIFA best player last year. Clubs like Chelsea and PSG also want am but the bobo don decide to go Barca even agree 3 years verbal agreement with dem.

 

As e dey Go

I dey remind Victor Osimhen everyday to join Chelsea- John Obi Mikel

Published

on

Make Chelsea sack Pochettino if him no fit deliver the container- John Obi Mikel

Former Super Eagles skippo, John Obi Mikel don come outside dey shalaye say na almost everyday him dey chat Victor Osimhen dey remind am say make him no join any other club wey no be Chelsea because na club wey go favour am be that.

Osimhen wey be the current African footballer of the year dey currently play for Napoli but everybody believe say soon and very soon the Nigerian hit man go need to leave the club for something bigger.

And Mikel wey be former Chelsea player and legend after him carry them win Champions League believe say na him former club go fit Victor Osimhen pass. According to Mikel:

I know say many other clubs dey chook eyes for Osimhen matter. Clubs like PSG, Liverpool and even Manchester United dey toast am. But I believe say if you watch Chelsea now, our problem na say we no sabi put ball inside net. And the only work wey Osimhen sabi na to put ball into net. If that bobo come Chelsea, walai talai him go blow pass Timaya.

FIFA nominate Victor Osimhen for the 2023 Best Player Award
Mikel Obi also say na him dey act as Victor Osimhen agent for this parol. Him say Osimhen fit no be the most flashy player wey too skillful. But just like Haaland, Osimhen sabi put ball inside net and na wetin make am be big player be that.

Victor Osimhen na sharp shooter wey score 26 goals take help Napoli win Italian Serie A for the 2022/23 season. So far, the 25 years old striker don score 13 goals inside 21 appearances for Napoli this season including the hat trick wey him score against Sassuolo for Napoli last Serie A match.

 

Continue Reading

As e dey Go

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Published

on

Transfer news: PSG wan sign Marcus Rashford, Manchester United don agree price with Rabiot

Premier League legend, Alan Shearer don come outside dey draw ear give Marcus Rashford take dey warn am say, if you no take time and begin behave yourself, you go waste this your talent and your career. This one na after Marcus Rashford miss Manchester United FA Cup 4-2 win against Newport on Sunday.

According to Manchester United manager, Erik Ten Hag, Rashford miss the match because him call in sick on the Friday before the match say him no go fit make am. But reports show say Rashford been go one night club on that Wednesday go over enjoy and na since after that club naim wetin dey do am begin do am. Ten Hag say na internal matter so him go deal with am internally.

But this one don make many people dey wonder say which kind internal issue go make player no even turn up on the day of match? Alan Shearer also recall sometime last season when the same Marcus Rashford chop punishment after him arrive late for meeting before one of them league matches.

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Alan Shearer

Na this one don make Shearer wey be Premier all-time top scorer de shake head with pity say Rashford just want to waste him talent. According to the legendary striker:

Marcus Rashford get big talent o, but the problem now be say him just want to waste am. Because we see the boy when him serious last season na. But this season so far, I no know wetin be him problem, whether him get family problem abi him girlfriend dey give am problem, or maybe na just village people, we need to help this boy and find out wetin be the problem otherwise him go just waste him career for nothing.

Alan Shearer also advice Rashford to find better manager and surround himself with wise people wey go dey remind am say if him continue like this and him career end, then him go truly regret him life and him wasted talent.

For now we dey wait to see how Erik Ten Hag wan take resolve Marcus Rashford internal problems.

Continue Reading

As e dey Go

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Published

on

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

As AFCON 2023 don enter knockout stage wey them don pair Nigeria to play Cameroon for the Round of 16 so, Super Eagles legend, Segun Odegbami don come outside like KingKong dey beat him chest say this Cameroon match go too easy for Nigeria because we go beat them like small pikin.

This one dey come after the AFCON wey dey happen inside Ivory Coast progress from the group stage enter knockout stages. This talk confuse many people because even for the group stage self, the Super Eagles no really impress as them manage to score only three goals in their three matches still finish second for the group.

On top of that the ball wey them dey play no even dey sweet for eyes make we say na that one we take hold body self. But on top of all of this, Mathematical Segun believe say Nigeria wey no dey give fans joy go easily beat and eliminate five-time AFCON champions, Cameroon from the competition.

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Segun Odegbami believe say Cameroon no be Nigeria mate

According to Odegbami:

Na this Cameroon wey everybody dey fear naim go be our easiest match for this AFCON. Because all those their gidigbo football wey them like to dey play no go work for this new stadium wey we dey go. The former stadium wey them been dey play rough like farmland. But na this smooth pitch naim we go catch them take show them correct pepper.

Segun Odegbami also talk say the Super Eagles dey improve for them game because after drawing their first match them win the last two. According to the legend, na progressive that so no shaking for that Round of 16 match.

Nigeria go play Cameroon for their Round of 16 match wey go happen on Saturday by 9pm Nigeria time. Wetin you think about that match? Abeg tell us for comment section.

Continue Reading

Trending