Connect with us

Meet the players

Transfer news: Ronaldo don finally agree to stay Manchester United, Arthur Okonkwo don leave Arsenal

Published

on

For transfer news dis morning, e be like say the prodigal son of Manchester United, Cristiano Ronaldo don finally return to the club and based on wetin we see for him social media yesterday, the runaway striker don finally decide to stay complete him contract.

Na for one of him Instagram fan pages naim dem post say e be like say the GOAT go miss United friendlies against both Atletico Madrid on Saturday and Rayo Vallecano on Sunday. But Ronaldo respond for the comment section say: make una forget dat list, una see dat Sunday match against Rayo, the King must play.

Ronaldo don dey find way to japa from Manchester United since wey transfer window open sotay him manager don dey kiri the bobo like aboki dey kiri yam but despite everything, dem no find buyer. Although dem been claim say dem fit don get buyer, dis latest positioning now be like Ronaldo don finally use him teeth take count him tongue.

Naija blood Arthur Okonkwo don leave Arsenal on loan

Transfer news: Ronaldo don finally agree to stay Manchester United, Arthur Okonkwo don leave Arsenal

Arthur Okonkwo for match with Arsenal

Young Naija blood, Arthur Okonkwo wey be Arsenal third choice keeper don finally leave the club go join Crewe Alexandra on loan. Crewe Alexandra dey play for League Two wey be the 4th highest league for England.

Arthur wey dey just 20 years old don dey Arsenal almost all him life. The tall keeper make 7 EPL appearances for bench last season and though many people dey yan say make Arsenal just kuku sell the guy because dem get many goalkeepers already, Arsenal no gree unto say dem get hooge plans for the boy.

Chelsea wey need striker wan go sign midfielder

Chelsea transfer window no dey show sign of encouragement because after signing Coulibaly put for defense, all the other moves wey dem dey make to try hijack other clubs jus dey backfire. Chelsea need striker so dem try to hijack both Gabriel Jesus and Robert Lewandowski transfer from Arsenal and Barcelona but e no work.

Transfer news: Ronaldo don finally agree to stay Manchester United, Arthur Okonkwo don leave Arsenal

Cesare Casadei na 19 years old central midfielder

Dem also need one more central defender so dem try to sign Jules Kounde but Barca show dem who the real bandit be by hijacking the bobo from dem. But since dem no fit get the striker and defender wey dem need, dem don kukuma decide to go buy midfielder wey dem no need because we don don dey hear now say dem wan buy Cesare Casadei from Inter Milan.

Casadei na 19 years old Italian central midfielder wey many people don already dey compare with Marco Veratti. The bobo cost only 8 million pounds for market and e be like say Chelsea wan kuku use da wan take dey hold body until dem see bigger name to sign.

Meet the players

Transfer news: Willian to join Fulham, Antony don complete Manchester United medical

Published

on

Transfer news: Willian to join Fulham, Antony don complete Manchester United medical

For transfer news today, former Chelsea and Arsenal winger, Willian don ready to return to EPL because we don dey hear now say the Brazilian don agree to join newly-promoted Fulham.

If una remember, Willian wey win Premier League, Europa League and FA Cup with Chelsea recently terminate him contract with Corinthians say him no wan play there again. And when dem ask am wetin e wan do next, him say na EPL him future dey which is why him don agree to join Fulham so.

Willian go complete him Fulham medicals today and sign the final contract. The Bros go bring plenty experience come the team although we no sure say him go dey available for dem EPL match with Brighton tonight.

Manchester United to unveil Antony

Transfer news: Willian to join Fulham, Antony don complete Manchester United medical

Manchester United go unveil Antony as dem player today

Manchester United don finally ready to unveil dem newest signing, Antony as a Red Devil today. Antony na big money signing wey cost Manchester United total of 85 million pounds to take drag am comot from Ajax wey no been wan let am go.

E don tay wey United coachie, oga Erik Ten Hag dey pursue the bobo sotay dem make 3 separate bids for the guy but Ajax no wan let am go say dem no get enough time to find him replacement. But after Antony make one emotional interview, Ajax finally release am. As e be now, him don complete medical and na to unveil am remain.

Edinson Cavani don join Valencia

Transfer news: Willian to join Fulham, Antony don complete Manchester United medical

Edinson Cavani show him class as a striker for Manchester United and PSG

Former PSG and Manchester United striker, Edinson Cavani don join Valencia on top 2 years contract. 35 years old Cavani join United for 2020 but although him show say him be world class striker, things worse for am after Cristiano Ronaldo join United wey even make am surrender him number 7 jersey.

 

Cavani finally leave Manchester United at the end of last season as a free agent and right now him don join Valencia to play for La Liga for the first time for him career. Cavani eben watch Valencia match last night wey dem lose 1-0 at home to Atletico Madrid.

Continue Reading

Meet the players

Transfer news: Manchester United ready to pay £80m for Antony, Leicester don reduce Tielemans bride price to £20m

Published

on

Transfer news: Manchester United ready to pay £80m for Antony, Leicester don reduce Tielemans bride price to £20m

For transfer news today, we don dey hear now say Manchester United don ready to increase dem bid for Ajax attacker, Antony to 80 million pounds. Manchester United don first drop 68 million pounds but Ajax reject am say if na crayfish United wan buy, dem better go find am for Oyingbo market.

Antony na one of oga Erik Ten Hag key transfer target dis transfer window and United don dey pursue the bobo since transfer start. Antony himsef wan join the Old Trafford club and him don tell the club say him mind no dey the club again so make dem sell am.

Antony na 22 years old Brazilian winger wey learn work for São Paulo before joining Ajax for 2020 on top 13 million pounds contract. Since then Antony don score 18 goals for 57 league matches. Him also follow for the Brazil U-23 team wey win Gold for Tokyo 2020 Olympics.

Leicester don reduce Tielemans bride price to about £20m

Transfer news: Manchester United ready to pay £80m for Antony, Leicester don reduce Tielemans bride price to £20m

Leicester don finally reduce hand for Tielemans bride price say dem go collect £20m last price

We don dey hear now say Leicester don ready to reduce hand for the money wey dem dey ask for Youri Tielemans so dat the bobo go fit find husband before him time expire. We hear say Leicester don ready to collect last price of 20 million pounds instead of the 38 million wey dem been dey ask for.

According to the tory, the reason why dem go down low na because the bobo remaining contract no reach 1 year again so e better make dem sell am now for around 20 million pass make dem let am waka for free. Arsenal don dey pursue dis guy since and now na dem opportunity to get am for cheap.

Hudson-Odoi fit join Bayer Leverkusen on loan

We don dey hear now say Chelsea winger, Callum Hudson-Odoi don dey warm up to join Bayer Leverkusen on top loan contract. Hudson-Odoi na one of the wingers like Pulisic and Ziyech wey no too see dem period under Chelsea coachie, oga Thomas Tuchel.

Transfer news: Manchester United ready to pay £80m for Antony, Leicester don reduce Tielemans bride price to £20m

Hudson-Odoi reject 2 EPL clubs to fit join Leverkusen and Chelsea don already wan sign Anthony Gordon to replace am

Hudson-Odoi problem start when him get injury for the month of March wey make am miss the rest of the season. But the bobo return when him mates dem go house for holiday, and the guy use dat period take dey train alone dey build him fitness. But e be like all that wan no dey enough because na loan him go end up.

Continue Reading

As e dey Go

Transfer news: Chelsea dey toast €150m Leao, Manchester United wan sign new keeper

Published

on

Transfer news: Chelsea dey toast Leao, Manchester United wan sign new keeper

For transfer news dis morning, we don dey hear now say Chelsea don dey plan to sign Rafael Leao from AC Milan. Chelsea really need attacking players because to score don become big problem for dem. And after dem return Romelu Lukaku and Timo Werner back to where dem come from, none of dem front 3 don score dis season.

Rafael Leao na Portuguese attacker wey get both speed and power wey don make many people talk say EPL football fit favour am. The only problem for dis Leao transfer now be say the bobo contract carry release clause of 150 million euros and we never sure if Chelsea go gree pay da kind money. Chelsea also dey target former Arsenal striker, Pierre-Emerick Aubameyang.

Manchester United wan sign new Kevin Trapp

We don dey hear now say Manchester United don drop marriage proposal give Eintracht Frankfurt to take sign their keeper, Kevin Trapp comot from the club straight to Old Trafford. After the kind akpere performance wey De Gea perform against Brentford, maybe na da wan make the club begin reading new keeper so.

Transfer news: Chelsea dey toast Leao, Manchester United wan sign new keeper

Kevin Trapp wey also be PSG Number 1 before, win Europa League with Frankfurt last season

Kevin Trapp na 32 years old experienced defender wey even follow Germany win FIFA Confederations Cup for 2017. But the former PSG keeper also win many local trophies for Ligue 1 before winning the biggest one last season when him save Aaron Ramsey penarity to help Frankfurt beat Rangers and win the Europa League. We never sure how much United dey price the guy sha.

Ziyech dey wait to join Ajax from Chelsea

We don dey hear now say Chelsea winger, Hakim Ziyech don dey warm up to return to him former club, Ajax, after two years wey him join Chelsea from the same Ajax. According to the tory, na since May naim Chelsea don dey find way to offload the guy and now e be like say e finally don wan happen.

Transfer news: Chelsea dey toast Leao, Manchester United wan sign new keeper

Hakim Ziyech wan return back to Ajax

Na for 2020 naim Hakim Ziyech wey dey 29 years old join Chelsea from Ajax. Although him win UCL for him first season, e be like things no later go well between him and Thomas Tuchel wey make dem wan sell am now. Ajax jus dey wait now make Antony finally join Manchester United before dem go finally submit proposal to bring the bobo back to Eredivisie.

Continue Reading

Trending