As e dey Hot

Players and fans join hand beat referee to death for dashing player red card

Published

on

My people diswan na very worwor story as we don dey hear now say one referee inside El Salvador don kpai after players and fans join hand togeda beat am to stupor because him dash dem player red card. This worwor tory shele during the amateur league match inside Toluca Stadium wey dey for the country capital, San Salvador.

According to the tory, the ref, oga Jose Arnoldo Amaya wey dey 63 years old and get 20 years experience for the work, decide to send off the player of one of the clubs after giving am 2 yellow card to make am red. But na dat red card wey him flash the player naim turn the other players and fans of the club to terrorists as dem begin attack the ref, dey punch am, slap am, even carry 2 by 2 take dey plank am for all him body until the old man collapse.

Ref Jose Amayo wey fans and players join hand beat to death

After the referee collapse naim medical people rush first give am First Aid but when dem see say wetin dem beat the man pass dem power, dem immediately transfer am to Igbobi. Na when dem reach Igbobi naim doctor confirm to dem say the referee don suffer many internal injuries wey dey cause internal bleeding and as e be now, na God hand naim the old man life dey because na only divine healing fit save am.

Unfortunately, even divine healing no reach to save oga Jose Arnoldo Amaya as the bros eventually give up the ghost and log out for hospital there. Na all diswan don make many people for El Salvador use anger take dey protest say enough is enough because the way fans dey attack match officials all over the country, not even bandits and unknown gunmen don do reach da wan.

Everybody don join mouth dey pressure the police to make sure say dem arrest those criminal fans wey kill the referee and make sure say dem no escape the thunder wey suppose fire dem but up until now, El Salvador police never arrest one single person and so far, e no be like say dem plan to arrest anybody.

Featured Image na picture of FIFA ref (not Jose) wey dey give yellow and red card.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version