Connect with us

As e dey Hot

Players and fans join hand beat referee to death for dashing player red card

Published

on

My people diswan na very worwor story as we don dey hear now say one referee inside El Salvador don kpai after players and fans join hand togeda beat am to stupor because him dash dem player red card. This worwor tory shele during the amateur league match inside Toluca Stadium wey dey for the country capital, San Salvador.

According to the tory, the ref, oga Jose Arnoldo Amaya wey dey 63 years old and get 20 years experience for the work, decide to send off the player of one of the clubs after giving am 2 yellow card to make am red. But na dat red card wey him flash the player naim turn the other players and fans of the club to terrorists as dem begin attack the ref, dey punch am, slap am, even carry 2 by 2 take dey plank am for all him body until the old man collapse.

Players and fans join hand beat referee to death for dashing player red card or El Salvador

Ref Jose Amayo wey fans and players join hand beat to death

After the referee collapse naim medical people rush first give am First Aid but when dem see say wetin dem beat the man pass dem power, dem immediately transfer am to Igbobi. Na when dem reach Igbobi naim doctor confirm to dem say the referee don suffer many internal injuries wey dey cause internal bleeding and as e be now, na God hand naim the old man life dey because na only divine healing fit save am.

Unfortunately, even divine healing no reach to save oga Jose Arnoldo Amaya as the bros eventually give up the ghost and log out for hospital there. Na all diswan don make many people for El Salvador use anger take dey protest say enough is enough because the way fans dey attack match officials all over the country, not even bandits and unknown gunmen don do reach da wan.

Everybody don join mouth dey pressure the police to make sure say dem arrest those criminal fans wey kill the referee and make sure say dem no escape the thunder wey suppose fire dem but up until now, El Salvador police never arrest one single person and so far, e no be like say dem plan to arrest anybody.

Featured Image na picture of FIFA ref (not Jose) wey dey give yellow and red card.

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

As e dey Hot

Golden Eaglets don jabo from U17 AFCON after Burkina Faso beat dem 2-0

Published

on

Golden Eaglets lose 1-0 to Morocco for dem second U17 Afcon match

The Golden Eaglets of Nigeria don jabo from the 2023 U17 AFCON championship after Burkina Faso beat dem 2-1 for their quarter final match wey shele dis night inside Algeria there.

The match open from the beginning sotay the two sides dey get opportunity wey dem just dey squander anyhow.

But na calamity defending lead to Burkina Faso first goal when one Burkina winger collect the ball from the right, cancel 2 Naija defenders before bending the ball wey keeper save. But instead of defenders to clear the line, dem dey there dey drag leg until Aboubacar Camara put am inside net to make am 1-0.

Golden Eaglets don jabo from U17 AFCON after Burkina Faso beat dem 2-0

Burkina Faso beat Golden Eaglets 2-1

 

The boys enter second half begin play under pressure and na another defensive error cause the second goal after one Burkina striker push ball inside 18 only for Naija defender to bring am down clumsily for penarity. The same Aboubacar Camara naim coolly convert the pk to make am 2-0.

But the boys no give up on demsef as dem begin dey pressure Burkina Faso until one ground crossing come in from the left wey one Naija striker flick enter Abubakar Abdullahi leg to tap in to empty net make am 2-1 and game on.

The boys try dem best to equalise but as usual, their inability to score goals become their biggest problem as Burkina Faso hold on to nak Nigeria comot for the 2023 AFCON U17 championship.

 

Continue Reading

As e dey Hot

Golden Eaglets lose 1-0 to Morocco for dem second U17 Afcon match

Published

on

Golden Eaglets lose 1-0 to Morocco for dem second U17 Afcon match

Naija Under-17 national team, the Golden Eaglets don lose 1-0 for dem second Group B match inside the ongoing U17 AFCON completion wey dey shele inside Algeria.

Immediately match start wey Morocco pass the kick off naim dem carry the ball shoot one shot wey deflect inside net to make am own goal for Tochukwu Ogboji and 1-0 for Morocco.

But the Golden Eaglets take over from there begin press Morocco dey pressure dem sotay dem no even fit cross halfway line. But the problem be say whenever dem get opportunity dem dey miss am anyhow, even some clear chances wey dem just dey balloon anyhow.

The boys enter second half continue dey press Morocco while the Atlas Cubs continue dey defend like say dem life depend on am. But dat wan no stop the Naija boys from breaking dem down but the problem be say, even from close range all the Eaglets shot just dey go off target.

Golden Eaglets lose 1-0 to Morocco for dem second U17 Afcon match

The Atlas Cubs of Morocco beat Golden Eaglets 1-0

Una remember say Super Eagles skippo, Ahmed Musa promise this boys N500,000 for each goal wey dem score for dis competition. We no come know whether na dat promise dey affect dem wey dem go see big chances dey miss am upandan.

The Atlas Cubs secure all 3 points for the match and dem second clean sheet of the competition. As e be now, Morocco dey top Group B with 6 points while Naija dey second with 3 points.

The Golden Eaglets go play South Africa next on Saturday to decide whether dem go qualify directly from the group or qualify as best losers since na only 3 groups dey the competition.

Continue Reading

As e dey Hot

Na against Man City I go know whether Arsenal players preeq still dey stand- Gallas

Published

on

‘We dash City goals, but Arsenal go still win Premier League’ - Arteta

As Arsenal dey prepare to jam Manchester City for their win or die match wey go shele on Wednesday, former Arsenal defender, William Gallas don come outside dey yan say na for that match him go know whether Arsenal players get balls abi make dem sope otilo.

Arsenal don run through majority of the season on top of Premier League table sotay many fans don give up say make dem kuku leave the league for dem. One supercomputer sef don predict dem to win the whole thing.

But na now wey season dey round up naim Mikel Arteta boys come dey prove to be dem own biggest enemy. First dem squander 2 goals against Liverpool to draw 2-2. Then dem squander another 2 goals to draw 2-2 against West Ham.

But the one wey pain many fans pass na Southampton wey no get demsef come Emirates score 3 goals sotay Arsenal need late equalizer to draw the match 3-3 to make am hat trick of draws for the North London club.

Despite Haaland goals, Saka get impact pass am this season- England Legend

Manchester City kpokpo Arsenal 3-1 for Emirates for the first leg

Na diswan don make many people conclude say for dem to crumble when it matters most, Mikel Arteta and him boys no get wetin e take to win the league. But William Gallas believe say na on Wednesday we go find out whether true true the boys still get balls or not.

”Wetin I wan talk now, I know say some people no go like am but na the simple truth. Na on Wednesday against Manchester City I go know whether Arsenal players still get preeq and whether dem preeq still dey stand. I wan see which of the players go man up and which wan go be woman wrapper.”

Arsenal go face Manchester City on Wednesday night for Etihad. Many people believe say The Gunners don already squander their opportunity to win the league and on Wednesday night, Pep Guardiola go put the nail inside their coffin bury dem.

Continue Reading

Trending