Connect with us

As e dey Go

Mudryk believe say Chelsea go first Arsenal win UCL that’s why him sign for them

Published

on

Mudryk believe say Chelsea go first Arsenal win EPL and UCL that’s why him sign for them

Mykhailo Mudryk don sign for Chelsea but the transfer still dey cause plenty gbege because we don dey hear now say one of the main reason wey make the 22 years old Ukrainian dump Emirates for Stamford Bridge na because him people believe say Chelsea go first Arsenal win Premier League and Champions League.

Una remember say na Arsenal first begin pursue Mudryk dey toast am for nearly 6 months sotay the boy don even begin wear Arsenal jersey dey watch all Arsenal games. Na all these things been dey give Arsenal fans hope say the boy ready to return the love wey them dey show am by signing for The Gunners.

But Mudryk break the heart of Arsenal fans as well as them board when just after 10 hours of meeting Chelsea people, him rush follow them like Slay Queen dey rush follow Sugar Daddy. But now we don dey hear the real reason why the bobo dump the Gunners for The Blues.

Mudryk believe say Chelsea go first Arsenal win EPL and UCL that’s why him sign for them

Na Chelsea second oga naim mastermind the way wey them arrange remove milk and honey from Arsenal mouth

According to Shakhtar Donetsk oga kpatakpata, oga Sergei Palkin, na the same £88m wey Arsenal bring naim Chelsea bring. £62m for sign on and £26m for bonus. But na the issue of how them go take pay the bonus na there problem dey.

Him say while the two clubs propose to pay bonus if the player win Premier League and UCL with them, them no believe say Arsenal serious enough about winning those trophies in the next 5-6 years wey them wan sign Mudryk. According to the man:

”We check the plans of the two clubs and we see am say na Chelsea serious pass because na them show us how them plan to win the EPL and UCL. Forget say them dey play igbakugba now, all na part of the process when club get new owner. When Chelsea finally balance, them go win everything. But for Arsenal, we no too sure about them.”

Na Chelsea second owner, oga Behdad Eghbali naim use private jet fly go meet Mudryk and him people for Turkey and na the same private jet him take carry the boy back to Stamford Bridge, nak am Victor Moses former jersey number 15.

As e dey Go

Mudryk dey learn work where Saka dey – Steven Gerrard

Published

on

Mudryk dey learn work where Saka dey - Steven Gerrard

After Mykhailo Mudryk fumble upandan during Ukraine friendly match with England on Sunday, Premier League legend, Steven Gerrard don come outside dey shake head say this guy still get very long way to go.

Steven-G dey yan this one after the Chelsea winger fail to track down Bukayo Saka sotay the bros even fall yakata before Saka locate Harry Kane to score England first goal for the 2-0 beating.

Na the same Saka score the second goal after making one sweet drive before unleashing one wucked long-rage shot inside net wey make Mudryk Ukraine teammate, Oleksandr Zinchenko confess say na Saka be the best player for Premier League.

Mudryk believe say Chelsea go first Arsenal win EPL and UCL that’s why him sign for them

Chelsea splash hooge money take hijack Mykhailo Mudryk from Arsenal nose

Na the same performance make Steven Gerrard come outside use sliding tackle take dey fire Mudryk say if na like this him dey play, that means him journey still long and him get a lot to learn. According to the Liverpool legend:

”Walai talai if na me be Ukraine coachie, that igbakugba wey Mudryk play go annoy me well well. What a disappointing display. With the speed and power wey him get, yet Saka chance am like paper weight. The guy na learner and I hope say him learn quick.”

Na Arsenal been wan sign Mykhailo Mudryk for January transfer window until Chelsea rush go hijack the bobo from the back door on top £88 million contract. But the bobo never see him period since him arrive Stamford Bridge with 0 goals and 1 assist to him name.

Continue Reading

As e dey Go

We buy ticket for Super Eagles to give us joy, instead them increase our anger – fans

Published

on

We buy ticket for Super Eagles to give us joy, instead them increase our anger - fans

After the Super Eagles of Nigeria lose 1-0 to Guinea Bissau last night for Abuja, fans don dey react with provocation say in the midst of all the problems and suffer wey them dey face inside the country, national team no fit give them small joy.

Nigeria host Guinea Bissau for the third match of their Group A AFCON qualifying group. Na Naija been dey top the group with 6 points before the match after beating both Sierra Leone 2-1 and São Tomé 10-0.

Na wetin make many fans believe say the Super Eagles go sweep the group stage clean and no be ordinary Guinea Bissau go stop them for Abuja. But na when match start we begin see am say this Bissau people no come Abuja come help INEC count ballot.

The Super Eagles start well but immediately Mama Balde score the only goal of the match for the 29th minute, e just be like say dem use pin take deflate all Naija players morale. From there na only igbakugba them just dey play until 90 minutes over.

We buy ticket for Super Eagles to give us joy, instead them increase our anger - fans

Guinea Bissau score the only goal of the match

Na wetin make many fans don dey react about the match with many of them insisting say the Super Eagles fall their hand kpatakpata. According to one fan, Mudasiru, him carry 2k wey him for take cook pot of soup go pay for match ticket only to return with anger.

”I buy ticket 2,000 to watch Super Eagles beat Guinea Bissau and make me happy, but instead na anger follow me reach house. Na the same thing them do me against Ghana. I no sure say I go watch Super Eagles match again.”

Another fan, Jerry, say make we no dey whyne ourself again, Naija no get national team because foreign-based players dey feel like Alhaji and coachie no dey ever invite home-based players wey still dey hungry pass lion.

”Peseiro suppose know by now say the earlier him begin integrate home-based players for the team the better for us. Home base players still get hunger for success unlike those foreign based players wey believe say them don arrive.”

As for another fan, Ogugua say the problem na that Abuja stadium because that stadium na neutral ground. According to am, the stadium always scanty whenever Super Eagles dey play match and the fans no dey connect with the players. So him dey recommend Uyo stadium.

Super Eagles currently dey 2nd for the Group A qualifying table with 6 points. Na Guinea Bissau dey top the group now with 7 points.

Continue Reading

As e dey Go

Arsenal best physio follow Partey go Ghana to prevent injury during international break

Published

on

Arsenal best doctor follow Partey to Ghana to prevent injury during international break

As Thomas Partey don travel to Ghana to play for him national team during international break, we don dey hear now say Arsenal send their best number 1 physiotherapist with am to make sure say the bobo no return with any injury.

Thomas Partey na one of the most important players for this Arsenal team wey dey hustle to win their first Premier League title in nearly 20 years. Unfortunately, the former Atletico Madrid man na also the most injury prone player.

And whenever him sustain injury, the team dey suffer because him no get solid replacement. Elneny wey dey replace am before sustain season-long injury since January. Arsenal try to replace the replacement with Moises Caicedo but Brighton no gree.

In the end The Gunners settle for Jorginho from Chelsea and although him dey try him best, you go just know say if no be Panadol e no fit be like Panadol. This is why Arsenal dey try protect their biggest asset by sending their best physio to dey monitor am.

Arsenal best doctor follow Partey to Ghana to prevent injury during international break

Thomas Partey dey with Ghana for international break

Ghana go host Angola for them Group E AFCON Qualifiers today before travelling to Angola for the second leg on Monday. Last time wey Partey go International break for September 2022, the bobo carry injury come back.

But Arsenal wey dey top table with 5 points difference no fit risk that kind injury now. Na just 10 matches remain and those matches include Liverpool, Newcastle and Manchester City away, then Chelsea for Emirates. Mikel Arteta boys need Partey now.

Continue Reading

Trending