Connect with us

As e dey Go

Messi fit play for Barca next season as Xavi don dey beg am to come back home

Published

on

Messi fit play for Barca next season as Xavi don dey beg am to come back home

We don dey hear now say Barcelona don start the process of bringing Lionel Messi back to the Camp Nou because their Vice President, oga Rafa Yuste don confirm say the Catalan giants don open negotiation to bring the World Best back to Camp Nou.

Messi leave Barca nearly 2 years ago after the club no fit afford to dey pay am again. And now, after playing 2 seasons for PSG, the seven-time Ballon d’Or winner look set to leave the Paris club after negotiations break down.

PSG say them no longer fit afford to pay Messi salary after Uefa nak dem fine of £8.6 million on top financial fair play matter. Another £56.3 million fine dey load if them no cut their cost and continue to dey spend money wey them no get like Yahoo Boys.

With Messi planning to leave, the matter now na which club go fit afford to pay am at least £740,000 a week wey him dey collect for PSG. Al-Hilal inside Saudi Arabia  don dey toast am to join them and compete against Cristiano Ronaldo there while Inter Miami inside US say them wan nak am the biggest contract in football history.

Our romance with Lionel Messi never end- Barcelona presido

Lionel Messi cry like small pikin when him finally leave Barcelona after 17 years of GOATness

We no con know whether Barcelona get the kind money to fund Lionel Messi movement but the club look like them serious on top the matter. Sotay Barcelona coachie, oga Xavi wey be Messi former Barca teammate don even dey beg am to return back home:

”I know say the money matter na serious matter but the truth be say, Camp Nou na Lionel house and the man need to come back home. Messi na my paddy, I go happy if him dey my squad and I sure say the fans go love am too. Messi need to return for one last romance with us.”

As e dey Go

Victor Osimhen refuse to play penarity for Napoli after TikTok admin use am do yeye

Published

on

Victor Osimhen apologise to Napoli coachie

My people e be like say Naija striker, Victor Osimhen don comot body from penarity matter for Napoli. Dis na because when Napoli win penarity kick for dem first goal during dem match with Udinese last night, when everybody dey expect Osimhen to carry tha ball play the thing as Napoli penarity taker, the 24 years old striker no even near there.

Na diswan make him Napoli teammate, Piotr ZielinskI carry the ball, convert the penarity to make am 1-0 for Napoli. Na Victor Osimhen score the second goal as the Serie A defending champions finally win the match 4-1.

Una remember say gbege burst during Napoli last match when dem draw 0-0 with Bologna. As the club dey hustle for goals during that match naim ref nak dem penarity. As dem penarity taker wey him be, Victor Osimhen step up only to play the ball off target.

Maybe Na diswan make coachie, Rudi Garcia substitute the Super Eagles striker from the match wey make Osimhen provoke hala for the coachie. Although the boy later apologise to the coachie and him teammates, da wan no stop Napoli TikTok people from using one short video take yab the boy.

FIFA nominate Victor Osimhen for the 2023 Best Player Award

Inside the video, dem show Osimhen dey beg for penarity and when dem give am the penarity, him troway am. The video contain all dis baby-baby voice wey dey pain well well if na you dem dey use am against. The TikTok video provoke many Naija people wey make dem vex go pressurize Napoli until dem delete the video.

The thing pain Victor Osimhen well well too wey make him agents release statement say dem ready to sue Napoli for dat kind nonsense behaviour. Although the bobo show professionalism to still turn up for dem match last night despite the provocation, him refuse to shake hands with some of him teammates. And now, the boy don comot body for anything penarity for Napoli.

 

Continue Reading

As e dey Go

Victor Osimhen apologise to Napoli coachie for him behaviour when dem sub am

Published

on

Victor Osimhen apologise to Napoli coachie

Napoli striker, Victor Osimhen don knee down for ground dey apologise to him coachie and teammates for the worwor behaviour wey him behave when dem coachie, oga Rudi Garcia substitute am comot during dem 0-0 draw away for Bologna on Saturday.

That particular match tie wrapper well well even as Napoli manage 12 attempts but only 4 naim go on target. As the attack dey shoot off target naim coachie decide to remove Osimhen for the 86th minute even though him score one goal wey VAR disallow.

But the substitution no go well with Osimhen as the Super Eagles striker begin hala for the coachie say why him go remove for dis kind match wey tie wrapper so upon the big striker wey him be. But Victor Osimhen don come outside today dey apologised today dey apologise say him no mean any of those things wey him talk. According to am:

Make una forgive me for all those things wey I talk because na overheating make my blood just dey hot wey make me begin overreact. I no mean anything wey I talk then and na my competitive spirit make me talk those things as e dey pain me say we never fit score for dat match.

‘Sell Maguire, add money buy Osimhen’ - Manchester United fans to Ten Hag

Victor Osimhen score the goal wey give Napoli the league last season

Napoli wey be Serie A defending champions no dey defend dem title well at all because out of five league matches so far dis season, Napoli don win two, draw two and lose one. This form naim carry dem balance for 7th place on top Serie A table with only 8 points.

Alrhough Napoli oga dem say dem still trust the coachie, oga Rudi Garcia to lead dem well, dem don give am warning to begin win matches and get results otherwise sack letter dey wait for am.

Continue Reading

As e dey Go

Ramsdale papa say Caragher na agbaya for calling him pikin hater

Published

on

Ramsdale senior sey Carragher nah disgrace

Arsenal goalkeeper, Aaron Ramsdale papa don tear shirt tear bra onto say Liverpool legend, Jamie Caragher, say him pikin nah olofofo wey dey pretend like sey him dey happy for others but inside their mind, dem dey pray sey the happiness nor last.

This one dey happen after camera capture Ramsdale wey dey for bench dey clap for Raya for one sweet save wey him make for the match between Arsenal and Tottenham wey end for 2-2 draw yesterday.

Carragher come go social media dey say Ramsdale nor actually dey happy for Raya and say the situation be like Oscar awards for people wey dey act film. Him say for the Oscar awards, you go see people wey nor win any award but nah so dem go dey smile and clap for the people wey win. But for their mind, dem dey vex. Caragher say nah exactly wetin Ramsdale dey do.

Ramsdale papa don change am for Carragher

Ramsdale senior sey Carragher sense dey do stop and start

Nah this bad bele make Nick Ramsdale wey be Aaron Ramsdale papa sey Carragher nah disgrace and sey him nor get class like him pikin get. Him sey Carragher nah person wey him sense dey do stop and start.

As e be so, e don clear sey Carragher dey sabi find talk wey talk nor dey. Him pundit work don give am the liver to dey talk to anybody as him like. This Ramsdale matter don become wetin many football people don use know Carragher. We just hope sey dem nor go break him head one day.

Continue Reading

Trending