Connect with us

As e dey Hot

Guardiola say him no regret selling Jesus and Zinchenko to Arsenal

Published

on

Guardiola say him no regret selling Jesus and Zinchenko to Arsenal

As two former Manchester City players, Gabriel Jesus and Oleksandr Zinchenko don help Arsenal dey top Premier League table, 5 points on top their former club, their former coachie, Pep Guardiola don come outside dey yan say him no regret selling the two players to Arsenal at all.

Una remember say na before season start naim Arsenal coachie, oga Mikel Arteta go raid him former club sign both Jesus and Zinchenko from there wey two of them cost around £70m. And since the two players join Arsenal, them don dey carry the club like aboki wey dey carry yam.

Na this one don make many people dey wonder whether Pep Guardiola no regret why him sell those players especially as him boys dey even struggle to win matches nowadays. But the back to back Premier League winning coachie don dey clear them say him no regret at all.

According to the man: “Shay na because them dey win without me go make me dey regret selling them? No na. I no be bad bele. In fact na me even happy pass self say Jesus and Zinchenko dey do very well.”

Guardiola say him no regret selling Jesus and Zinchenko to Arsenal

Guardiola say him love Zinchenko and Jesus

Pep Guardiola say him love the two players even when them still dey Manchester City and na because condition don too make crayfish bend naim make am decide to sell the players go where them go dey happy. Him also talk say Zinchenko get many opportunities to leave City but him still decide to stay until Arsenal finally carry am.

Manchester City dey host Arsenal for FA Cup on Friday night and that go be the first time wey both Zinchenko and Jesus go play against their former club since them leave.

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

As e dey Hot

£70m wey Arsenal price no reach to buy Caicedo one leg – Brighton CEO

Published

on

£70m wey Arsenal price no reach to buy Caicedo one leg - Brighton CEO

Brighton CEO, oga Paul Barber don come outside with vawulence this hot afternoon dey blast Arsenal say the club been dey price Brighton midfielder, Moises Caicedo like market woman dey price pepper and the money wey them bring no reach to buy the guy one leg.

Una remember say na for December wey Arsenal lose Mohamed Elneny to injury naim them begin run kitikiti to find replacement. Na this kitikiti them run go Brighton to sign their midfielder, Moises Caicedo. Arsenal desperate sotay them offer Brighton £70m for the 21 years old Ecuadorian.

But now, Brighton oga kpatakpata don dey clarify say that £70 million no reach to buy the guy one leg talk less of the full player. According to the man, Arsenal no serious enough:

“Abeg make una help me ask Arsenal wetin that 70 million be for. Because if na to sign Caicedo, then the money no even reach to buy half of the player. Moreover, we no dey release how much wey them price our players so the money wey Arsenal bring fit no even reach £70 million.”

£70m wey Arsenal price no reach to buy Caicedo one leg - Brighton CEO

Brighton CEO say Arsenal money no reach to buy half of Caicedo

Moises Caicedo na player wey Brighton sign on top 5 years contract on top salary of £182,000 a year. This mean say Brighton dey pay am only £3,500 a week. Na this one don make many people dey wonder why the club decide to block the guy road.

As Arsenal no fit get Caicedo, them kukuma rush go buy Jorginho from Chelsea to cover for Partey and so far, Arsenal still dey do well.

Continue Reading

As e dey Hot

Al-Hilal wan nak Messi £194m per year to join Saudi League

Published

on

Al-Hilal wan nak Messi £194m per year to join Saudi League

We don dey hear now say Saudi Arabia league club, Al-Hilal don dey prepare to nak Lionel Messi ogbonge contract of £194 million per year to dump PSG and any other club wey dey hustle and sign for them.

Messi wey be the current FIFA Best player of the Year currently dey play for PSG but him contract go end this season and the GOAT no ready to sign new contract with the Paris club.

So as e be now, the GOAT na hot market and many clubs go dey try to sign am. David Beckham club for America, Inter Miami wan sign the World Cup winner, promising to make am the biggest signing in football history. But nobody know whether Inter Miami get the kind money.

But if e get any country wey everybody agree say e get that kind money, na Saudi Arabia. And after Cristiano Ronaldo become the highest-paid player in football history after joining Al-Nassr inside Saudi, many people expect Messi to eventually go there go chop pension funds.

Akoi Grace! Cristiano Ronaldo Al Nassr jersey don dey sell like hot akara

Messi biggest rival, Ronaldo dey play for Al-Nassr inside Saudi

And now, Al-Nassr biggest rivals, Al Hilal don dey line up ogbonge contract for Lionel Messi. The matter serious sotay paparazzi people don site Messi papa wey also be him agent, Daddy Jorge for Riyadh.

Although Lionel Messi papa na Saudi ambassador, many people believe say him dey Riyadh to negotiate mighty contract for him pikin. Messi dey plan to win him 8th Ballon d’Or later this year and e no sure whether playing for Saudi Arabia go help am win am.

Al-Hilal currently get transfer ban. But that ban go expire at the end of this season which mean say them get the liberty and plenty money to sign players as them want. But e fit pay them to just sign the best player in the world to help them rival Al-Nassr and Ronaldo.

Continue Reading

As e dey Hot

Casemiro go chop more red cards if him continue dey play bandit football – former EPL ref

Published

on

Casemiro go chop more red cards if him continue dey play bandit football - former EPL ref

After Casemiro chop straight red card during Manchester United Premier League match with Southampton on Sunday, former EPL referee, oga Graham Poll don dey warn the United defensive midfielder say make him ready to chop more red cards if him continue with this bandit soccer wey him dey play.

Casemiro chop him second red card as a Manchester United player as them play 0-0 with Southampton for Old Trafford. This na the same total number of red cards wey the 4-time UCL winner winner collect throughout the 336 matches wey him play for Real Madrid.

As e be now, the 31 years old midfield marshal go serve 4-match ban for the straight red card instead of the usual 3 because this na the second time wey him dey collect red card this season. And now, oga Graham Poll don dey warn am to ready to chop more cards unless him calm down.

According to oga Poll: if Erik Ten Hag know wetin good for am, him better warn Casemiro to calm down or else the red cards wey him go chop still dey load dey come. Because the guy game dey too aggressive and as a former ref, I go tell you for free say we dey always put eyes for those aggressive players.

Erik ten Hag don tell Manchester United players say you either shape up or shape out

Graham Poll don advice Ten Hag to give Casemiro better warning

Oga Graham Poll also point out say the fact say Casemiro still chop another red card this season after the first one against Crystal Palace mean say him never understand say him need to stop that bandit style of play and begin play safe instead.

Casemiro become the first Manchester United player to chop two red cards for one season since Nemanja Vidic for the 2013/2014 season. And right now, him go miss miss United FA Cup quarter-final against Fulham, dem EPL away match to Newcastle and Brentford and dem home match with Everton.

Continue Reading

Trending