Connect with us

As e dey Hot

FIFA hammer £143,000 fine on top Senegal say dem fans flash green torchlight for Salah face

Published

on

As e dey hot, we fit konfam give una say FIFA don hammer fine of 143,000 pounds on top the head of Senegal after dem investigation show say true-true Senegal fans behaviour no too pure after them shine plenty green-green torchlight inside the face of Mohamed Salah jus before him play dat penarity for dem World Cup qualifying second leg match wey shele for Senegal.

Una remember say after the match, Egypt players and officials give report say wetin dem eyes see for Senegal, walai talai dem mouth no fit talk am finish. Dem say na from their journey from hotel to stadium wey far pass from Jerusalem to Jericho naim Senegal fans don begin attack dem dey stone dem bus with bottle, rotten egg, stone, anytin wey fit wounjure human being. When dem finally reach stadium say make dem warm up, again fans begin stone dem dey insult dem even call dem all kind of racist name.

During the match about 100,000 green torchlight dey follow any Egypt player wey hold ball and after the match, upon say Senegal win, the fans still attack dem again sotay dem need special forces to take protect Salah. Na all dis tin naim FIFA investigate finish see say true-true Senegal fans na real agbero fans wey commit wetin onyibo dey call disgraceful conduct by flashing torchlight inside Egypt players eyes, invading the pitch after match and even carry one racist banner enter stadium.

All diswan show say Senegal FA no fit control dem fans behaviour wey make dem hammer dem dat fine of 143,000 pounds wey if Aboki change am for you, e go be 74.3 million Naira. Also Senegal go play dem next home match for empty stadium.

My people how una see dis kind fine wey Fifa don nak Senegal so?

As e dey Hot

I wan see more black coaches for professional football – Yaya Toure

Published

on

Black coaches deserve more chance according to Yaya Toure
What Guardiola and Mourinho can do, we can do put jara

Barcelona and Manchester City legend, Yaya Toure, don use microphone like hype man declare say more black coaches suppose dey professional football pass as e dey.

Yaya Toure wey leave Tottenham Hotspur U-16 for June this year go become assistant coach for Belgium with Standard Liege, don dey hala sey black coaches get everything wey any coach for world football need to succeed. According to am :

“My brother Kolo Toure nah the first and me don be second and e go continue like that. Black coaches go still become hot akara wey football clubs and national teams go dey rush. This nah because African coaches too get the ability to read and pass exams. In fact, nothing Guardiola and Mourinho fit do wey black coaches nor fit do”.

Black coaches deserve more chance according to Yaya Toure

What Guardiola and Mourinho can do, we can do put jara

Yaya sey him go like become the third coach to win African Nations Cup as player and coach after Muhammad El Gohary (1959 as player and 1998 as coach) and Stephen Keshi (1994 as player and 2013 as coach). Him say the opportunity don come before to coach him country, Ivory Coast but say him reject am because him never ready then. But say him don ready now.

Yaya Toure dey speak to journalists onto the African Nations’ Cup draw wey go shele on Thursday for Ivory Coast. Yaya and him brother follow for the Ivory Coast team wey win African Nations Cup for Equatorial Guinea 2015. As him don dey advocate for black coaches so, football people dey sey make black coaches sef dem try dey show workings sake of sey better soap nor need advert.

Continue Reading

As e dey Hot

Romelu Lukaku agents Roc Nation don drop am because him na bad market

Published

on

Romelu Lukaku agents Roc Nation don drop am because him na bad market
Lukaku issues don turn spiritual

Trouble don carry chair come balance for Romelu Lukaku house as e don clear sey Roc Nation wey belong to Jay Z don drop Lukaku from the list of players wey dem dey manage.

Roc Nation wey dey  also look after players like Marcos Rashford, Kevin de Bruyne, Wilfred Zaha, Samuel Chukwueze, Tyrone Mings, Eric Bailly and many others don comot all the photo wey resemble Lukaku comot for their website. People wey know as e dey go for football don confirm sey Lukaku and Roc Nation nor wan roll again.

Romelu Lukaku join Jay Z sports management company for 2018 after him leave Mino Raiola company after the super agent death. Nah the same Roc Nation carry am come Manchester United from Everton. Nah still dem carry am come Chelsea from Inter Milan last year. Nah still dem toast Chelsea wey dem for gree loan am go Roma after Chelsea bin sey nah only sell dem wan sell am.

Roc Nation wey belong to Jay Z don drop Lukaku

Lukaku matter don turn spiritual

This issue don dey make football people dey put 2 and 2 together because e never tay wey him betray Inter go discuss contract with Juventus for their back. E never tay too wey Juve fans dem carry fight go meet their club oga dem sey dem nor want Lukaku for their club. Then, Chelsea fans don play am tey-tey sey dem nor soro am onto how him insult their club for media under Thomas Tuchel.

All these issues put together don make Romelu Lukaku be like dog meat wey nobody wan buy. And as Roc Nation don decide to divorce am, we nor come know wetin happen gan-gan even as e clear sey Lukaku matter don turn spiritual.

Continue Reading

As e dey Hot

FIFA nominate Victor Osimhen for the 2023 Best Player Award

Published

on

FIFA nominate Victor Osimhen for the 2023 Best Player Award

FIFA don release dem 12 man shortlist of the official Best Player of the Year award and when we torchlight the list, we see am say our Naija Boy and Super Eagles hit man, Victor Osimhen stand gidigba inside the list.

Victor Osimhen carry Napoli win Serie A title last season, for the first time in more than 30 years. On top of that, the Naija boy become the first Naija man to win Serie A top scorer when him score 26 goals for the season.

E no end there as the 24 years old striker also overtake George Weah as the highest scoring African player for the history of Serie A when him score Napoli only goal wey dem take beat Fiorentina 1-0 back in May. That goal make am 47 goals for Osimhen while George Weah dey 46.

Over the weekend, Victor Osimhen score hat trick as Super Eagles destroy São Tomé and Principe 6-0 for the AFCON 2024 qualifiers wey shele for Uyo stadium.

FIFA nominate Victor Osimhen for the 2023 Best Player Award

Bleacher Report don help us with the nominations

Other players wey make the FIFA Best shortlist na Julian Alvarez of Argentina and Manchester City, Marcelo Brozovic of Croatia and Al-Nassr, Kevin De Bruyne of Belgium and Manchester City, Ilkay Gundogan of Germany and Barcelona, and Rodri of Spain and Manchester City.

Others na Erling Haaland of Norway and Manchester City, Khvicha Kvaratskhelia of Georgia and Napoli, Kylian Mbappe of France and PSG, Declan Rice of England and Arsenal, Bernardo Silva of Portugal and Manchester City, and Lionel Messi of Argentina and Inter Miami.

 

Continue Reading

Trending