As e dey Hot

Chelsea don remove Aubameyang name from UCL squad replace am with Enzo Fernandez

Published

on

My people no be small something dey shele for the career of Pierre-Emerick Aubameyang as we don dey hear now say Chelsea don remove the former Arsenal skippo name from them Champions League team list and replace am with Enzo Fernandez.

Chelsea enter market this January begin spend money like Yahoo Boys, even spend pass wetin them spend before season start. Them sign players like Noni Madueke, Andrey Santos, Benoit Badiashile, Mykhailo Mudryk, Denis Zakaria and Enzo Fernandez.

But now them don over sign players sotay when time reach to register them inside UCL squad, them see am say space no dey to register them. So to make space, them need to remove some players and after them look the squad finish, na Aubameyang them remove.

 

Chelsea splash hooge money take hijack Mykhailo Mudryk from Arsenal nose

According to Uefa rules, na only 3 new players clubs fit register after January transfer window and after registering Mykhailo Mudryk, Denis Zakaria and Joao Felix, no space to register Enzo Fernandez. Na wetin make oga Graham Potter quickly sacrifice Aubameyang to register them £107m pound player there.

Pierre-Emerick Aubameyang join Chelsea from Barcelona for August 2022. But the bobo never start any match for Chelsea since November, 2022. But the guy don start all Chelsea 6 matches for UCL. But now things wan go from bad to worse because even the UCL self, him no go see play again.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version