Connect with us

As e dey Go

Bring back Lukaku: Rio Ferdinand don advice Potter to bring back the £97.5m striker from loan

Published

on

Bring back Lukaku: Rio Ferdinand don advice Potter to bring back the £97.5m striker from loan

As Chelsea dey struggle to score goals wey dem go take win matches, Premier League legend, Rio Ferdinand don come outside dey draw ear give Graham Potter say time don reach to bring back dem big egunu, Romelu Lukaku wey dey outside on loan.

Na for August 2021 naim Chelsea enter market go sign Lukaku from Inter Milan with £97.5 million on top 5 years contract. But the Belgium striker no see him period under former coachie, oga Thomas Tuchel wey make dem bundle am back to Inter on loan after just one season.

And now the big striker don dey rediscover the form wey make Chelsea splash dat kind hooge money on top am, as him score the only goal wey Inter take beat Porto for dem Champions League match wey shele last night.

Make Chelsea never sack Potter, the coach need time - Guardiola

Chelsea dey fumble this season and at dis rate, dem fit no go Europe next season

Chelsea on the other hand just dey fumble and grumble upandan, winning 1 and losing 5 of dem last 9 matches and scoring only 1 goal in dem last 5 games. Na diswan don make Ferdinand believe say Chelsea need world class striker and dem already get one:

”Since na new coachie dey run the government for Chelsea now, I believe say him suppose give Romelu Lukaku chance to prove himself. Because if you check am, which proven striker dey Chelsea now? Aubameyang no even dey UCL squad, so na who the coachie fit trust to deliver the goals?”

Ferdinand say time don reach for Lukaku to return back home to Chelsea because him get the capacity and competence to deliver dem. Say the bobo always know where post dey and him never even fully fit yet him don bang goals for back to back matches wey him play. What if him come fit?

Romelu Lukaku contract with Chelsea remain 3 years which mean say the former Manchester United striker still get plenty time to make sure say the big money wey Chelsea sign am no be mistake. The problem now na weda the guy wan come back after the last experience under Tuchel.

 

As e dey Go

Small quarrel between Ronaldo and him babe, people begin lie say dem wan break up- Ronaldo mama

Published

on

Small quarrel between Ronaldo and him babe, people begin lie say dem wan break up- Ronaldo mama

Cristiano Ronaldo mama, Madam Dolores Aveiro don come outside dey point accusing finger give people wey dey spread rumour say her pikin wan break up him girlfriend, Georgina Rodriguez say their evil plan no go work because na lie dem dey lie.

Na some few weeks back naim rumour begin spread say there is fire on the mountain because Ronaldo and him baby mama don get serious kwanta and because of dat kwanta, Ororo dey plan to dump her and do her like Hakimi.

In fact na one Instagram babe begin spread dat rumour say na before the two lovebirds wan board flight to somewhere naim dem begin shout for each other dey quarrel for the whole public of Igwemmadu.

But e no tay afterwards when Georgina herself come outside dey mock people wey dey spread the rumour say na only mumu dey believe rumour wey jealous people invent begin spread shamelessly.

Small quarrel between Ronaldo and him babe, people begin lie say dem wan break up- Ronaldo mama

And now, Ronaldo mama herself don come outside dey chook mouth for the matter say all those things wey dem dey talk about her pikin and her daughter in-law na big big lies. According to her:

”Abeg una don see anywhere wey man and woman no dey quarrel? Even husband and wife sef dey quarrel. Da wan na normal thing. So we go come say because dem quarrel therefore them wan break up? Haba mana! Make una suffri dey lie na.”

Ronaldo himself don kuku post picture of himself and Georgina kissing and doing mushy-mushy for public to prove say nothing dey happen and the love between him and him baby mama still strong well well.

Continue Reading

As e dey Go

Make nobody blame Lampard, Guardiola and Mourinho no go do pass am – Makelele

Published

on

It’s not over, we still fit beat Real Madrid jabo for Stamford Bridge- Lampard

Chelsea legend, Claude Makelele come outside dey draw ear give everybody wey dey criticize Frank Lampard say make dem leave the poor man alone to focus on him job, after all, even Pep Guardiola and Jose Mourinho no go do pass wetin Lampard dey do.

E shock many people when Chelsea name Frank Lampard as the coachie to take over the club after dem sack Graham Potter. Before then, Frank Lampard don lose 7 and draw 2 of him last 9 matches as Everton coachie wey make the club sack am.

Therefore many people believe say Chelsea just jump from frying pan enter fire. Lampard himself no kuku disappoint them because him start him second term with loss and na so e continue for the next six matches sotay people begin wonder whether no be relegation the man dey carry dem go so.

Chelsea finally secure the first points of Lampard second term as Chelsea coachie when The Blues beat Bournemouth 3-1 away. That win also remove them from relegation battle as the 41 points make am mathematically impossible to suffer relegation.

Make nobody blame Lampard, Guardiola and Mourinho no go do pass am - Makelele

Claude Makelele na former Chelsea midfield jagaban

Yet e no stop many fans from criticizing the man say him na carpenter wey just dey parade himself as coachie. Na wetin don make Makelele come outside dey defend Lampard say no other coachie go do pass wetin him dey do so. According to the former Chelsea midfielder:

”Instead of to dey blame Lampard, una suppose to dey hail am. Because dis job wey him collect na job wey go cripple many coachie dem career. Even if you carry Pep Guardiola or Jose Mourinho put for dis particular situation, dem for still flop.”

According to the former Lampard teammate for Chelsea, na new players full this Chelsea team. Many of dem never play for big club like Chelsea so dem still dey find their way. Lampard no know dis players before now yet him still get mind collect the work. As such the man deserve praise not castigation.

Continue Reading

As e dey Go

6 players + coachie chop red card as River Plate vs Boca Juniors end in vawulence

Published

on

6 players + coachie chop red card as River Plate vs Boca Juniors end in vawulence

No be small vawulence shele inside Argentina league as the Superclasico match between River Plate and Boca Juniors end with one big fight after which 6 players and Boca Juniors coachie, Jorge Almiron chop straight red card.

The match shele for River Plate home stadium, Estadio Monumental with 83,000 fans watching. Nothing happen for the full 90 minutes of the match sotay scores sef na 0-0 after 90 minutes. But na for injury time after ref award River Plate penarity naim things begin happen.

After all the arguments and disagreements with referee by Boca Juniors players, Miguel Borja convert the penarity to give River Plate the lead.

Immediately after the penarity, instead of to go celebrate with him teammates, another River player, Agustin Palavecino decide to celebrate by shouting inside the face of Boca Juniors keeper, and former Manchester United keeper, Romero.

Na diswan make Boca Juniors players rush Palavecino begin harass am, dey push am, be like somebody even tear am slap. E no tay before River players wey been dey celebrate realise wetin dey happen, begin rush come to help their man. And just like that street fight don set o.

6 players + coachie chop red card as River Plate vs Boca Juniors end in vawulence

Na Palavecino and Romero start the fight

The players begin throw punches, dey throw slap, dey shout for each other, before we know wetin dey happen dem don slam one player for ground and just like that, the fight don worse pass before as even the coaches enter pitch to put hand for the matter.

In the end na stewards and riot police manager separate the fight after 15 minutes of war. After everybody don calm down, referee nak 6 players red card, 3 from each side.

Agustin Palavecino wey start the gbege, Ezequiel Ignacio Centurion and Elias Gomez collect for River Plate. Na Miguel Merentiel, Ezequiel Fernandez and Nicolas Valentini collect for Boca Juniors. Romero escape even though na him punch somebody put for ground.

Continue Reading

Trending