Connect with us

Wetin shele gan-gan

Arsenal lokan: Ogbonge computer don predict Arsenal to win Premier League dis season

Published

on

Arteta lokan: Super computer don predict Arsenal to win Premier League

Arsenal fans go like dis tory well well because one ogbonge super computer don predict say na The Gunners go break Manchester City Premier League dominance dis season because na dem go win the EPL title this season.

Even though na Arsenal dey top league now, the mind of them fans no rest at all because apart from the fact say na only 1 point separate them from Manchester City and Tottenham on top the Premier League table, the Gunners wey everybody know na the ones wey dey start season well with initial gragra only to flop when season finally tie wrapper.

Arteta lokan: Super computer don predict Arsenal to win Premier League

Just like elephant wey climb tree, everybody believe say Arsenal go finally crash down

But this super computer don dey tell Arsenal fans make dem relax and enjoy themself because you see dis season wey we dey so, Arsenal lokan. Na dem get am and based on logistics, Arteta will bring it home.

According to the supercomputer wey belong to Football Web Pages, Arsenal go win premier league with 86 points, 3 points above Manchester City wey go finish second. The computer predict say although Manchester City go win all dem home matches, Arsenal go still overthrow them as EPL champions.

Brighton and Tottenham also no go lose for home and the two of them go finish third and fourth. The computer also predict say Liverpool no go win any single away match and West Ham go finish last for table and dem go win only 1 home match the full season.

Arsenal never win premier league since 2003/2004 which is nearly 20 years now. Meanwhile club like Manchester City don win am 4 times in the last 5 years. True true dis life no balance but if The Gunners go win the league dis season, things go balance small. See the final league standing wey the supercomputer predict:

Arteta lokan: Super computer don predict Arsenal to win Premier League

Final league standing according to the supercomputer

As e dey Go

Victor Osimhen refuse to play penarity for Napoli after TikTok admin use am do yeye

Published

on

Victor Osimhen apologise to Napoli coachie

My people e be like say Naija striker, Victor Osimhen don comot body from penarity matter for Napoli. Dis na because when Napoli win penarity kick for dem first goal during dem match with Udinese last night, when everybody dey expect Osimhen to carry tha ball play the thing as Napoli penarity taker, the 24 years old striker no even near there.

Na diswan make him Napoli teammate, Piotr ZielinskI carry the ball, convert the penarity to make am 1-0 for Napoli. Na Victor Osimhen score the second goal as the Serie A defending champions finally win the match 4-1.

Una remember say gbege burst during Napoli last match when dem draw 0-0 with Bologna. As the club dey hustle for goals during that match naim ref nak dem penarity. As dem penarity taker wey him be, Victor Osimhen step up only to play the ball off target.

Maybe Na diswan make coachie, Rudi Garcia substitute the Super Eagles striker from the match wey make Osimhen provoke hala for the coachie. Although the boy later apologise to the coachie and him teammates, da wan no stop Napoli TikTok people from using one short video take yab the boy.

FIFA nominate Victor Osimhen for the 2023 Best Player Award

Inside the video, dem show Osimhen dey beg for penarity and when dem give am the penarity, him troway am. The video contain all dis baby-baby voice wey dey pain well well if na you dem dey use am against. The TikTok video provoke many Naija people wey make dem vex go pressurize Napoli until dem delete the video.

The thing pain Victor Osimhen well well too wey make him agents release statement say dem ready to sue Napoli for dat kind nonsense behaviour. Although the bobo show professionalism to still turn up for dem match last night despite the provocation, him refuse to shake hands with some of him teammates. And now, the boy don comot body for anything penarity for Napoli.

 

Continue Reading

As e dey Go

FIFPRO don warn NFF to pay Super Falcons dem money or…..

Published

on

Naija Super Falcons lose dem first match for WAFCON against South Africa
Football Yarns

International Federation of Professional Footballers wey be FIFPRO for short don chuk mouth for the money wahala between the Nigerian Football Federation (NFF) and the Super Falcons wey just jabo from the ongoing FIFA Women’s World Cup wey dey shele for Australia and New Zealand.

FIFPRO nah the organization wey dey look after players dem welfare for world football. If e get any player anywhere in the world wey be sey dem wan cheat or run street, dem go rush go there like Superman go settle the matter.

Nah the same FIFPRO don visit Super Falcons matter and don assure dem sey all of dem go receive all the money wey NFF don dey owe dem since 2021. FIFPRO dey look after more than 65,000 footballers for world football sey:

‘We go like thank all the Super Falcons players and staff for their professionalism before, during and after dem jabo from the World Cup. We dey assure una sey all of dem go collect their money even 10kobo nor go remain. This nah wetin we dey do for our members’

FIFPRO don warn NFF to pay Super Falcons dem money or…..

FIFPRO go make NFF pay Super Falcons

We go remember sey Super Falcons almost collect walk-over for World Cup because of unpaid salaries and bonuses. But dem finally nor allow the matter distract dem as dem qualify for group wey get Australia and Canada. Even if dem lose to England on penarity shootout, dem really show Naija to the world.

As e be so, money matter sure pass for dem now and as FIFA through FIFPRO don take up their case, football people don dey gyrate onto sey nah where person dey work person suppose chop.

Continue Reading

Wetin shele gan-gan

One Messi fan don lose him cleaner job after collecting Messi autograph

Published

on

One Messi fan don lose him cleaner job after collecting Messi autograph

No be only good good thing dey happen inside Miami since wey Lionel Messi enter the city because we don dey hear now say one Lionel Messi fan wey dey work as cleaner inside Inter Miami stadium don lose him job after him lose focus of him work just to collect Messi autograph.

According to the tory, the Messi fan, Mr Cristian Salamanca wey leave him village for Columbia enter America just to find work, finally get work as cleaner inside Inter Miami DRV PNK Stadium. But him first day for work naim turn out to be him last day as well when him decide say Lionel Messi autograph important pass the work wey him just get.

Cristian really plan the thing well because him wear Argentina jersey under him overall when him resume shift for the gate wey Inter Miami players go pass enter for dem last match against Orlando City. Na Lionel Messi enter last and immediately Cristian see Messi, him begin hail am like all this agberos dey hail big man for road dey call am Odogwu, Big Shoe, World Champion etc.

Immediately Lionel Messi turn to look who dey hail am like Pasuma so, na so the bros open him overall to reveal him Argentina jersey. Na da wan sweet Messi bele well well wey make am kukuma waka come meet Cristian use marker take sign autograph for the bobo Argentina jersey.

One Messi fan don lose him cleaner job after collecting Messi autograph

Messi fans dey worship am like god

The autograph make the Messi fan happy well well but him happiness no last because stadium workers get one law say dem no go harass players or even ask dem for autograph while on duty. Na dat rule naim Cristian break and immediately naim one security man come arrest am escort am go dem oga kpatakpata office where dem sack am with immediately alacrity.

But the Messi fan don come outside dey yan say if dem like make dem sack am 1 million times, dat single autograph wey him collect worth am well well. E say although him no like the way wey dem treat am, him no get any bad feelings because Messi don already give am everything him need.

Continue Reading

Trending