Connect with us

Wetin shele gan-gan

Armed robbers attack Aubameyang house, kpokpo him face thief all him bling-bling

Published

on

Armed robbers attack Aubameyang for house, dem kpokpo him face thief all him money and bling-bling

My people diswan na very worwor tory as we don dey hear now say some armed robbers attack Pierre-Emerick Aubameyang house inside Barcelona for Spain, kpokpo the former Arsenal captain well well before dem begin steal things from the house.

According to the tory, na for middle of night when the whole Aubameyang family dey enjoy dem Sunday sleep naim the bandits burs enter the house through the garden fence begin show all working.

Dem first use gun take threaten Aubameyang before dem lie am for ground in front of him wife begin punch am dey kick am even use iron rod take dey hit the guy like dem dey beat thief for Oshodi sotay him wife begin hala whether dem wan kill am.

Armed robbers attack Aubameyang for house, dem kpokpo him face thief all him money and bling-bling

Aubameyang, him wife Alysha Behague and dem two children inside the house

After dem don beat the guy beleful naim dem begin waka from one room to another dey thief everything wey dem fit carry. Dem enter Aubameyang kolo carry some money wey dem see before clearing all the guy bling bling from him gold necklaces to diamond neck chain, earring, nose ring, wristwatch, everything wey dey shine for eyes naim the hoodlum dem clear from the house.

As e be now, Barcelona police don dey on top the matter as dem dey try track down those arm robber dem. Aubameyang sef no gree go hospital because him no want make dem use bandage and plaster take decorate all him head and face so dat him pikin dem no go begin fear.

Aubameyang wey join Barcelona from Arsenal for January dey work on possible transfer wey go carry am back to London with Chelsea. The transfer don dey tay small but we no come know whether dis attack go make Aubameyang fast forward the movement make him relocate quick.

As e dey Go

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Published

on

Transfer news: PSG wan sign Marcus Rashford, Manchester United don agree price with Rabiot

Premier League legend, Alan Shearer don come outside dey draw ear give Marcus Rashford take dey warn am say, if you no take time and begin behave yourself, you go waste this your talent and your career. This one na after Marcus Rashford miss Manchester United FA Cup 4-2 win against Newport on Sunday.

According to Manchester United manager, Erik Ten Hag, Rashford miss the match because him call in sick on the Friday before the match say him no go fit make am. But reports show say Rashford been go one night club on that Wednesday go over enjoy and na since after that club naim wetin dey do am begin do am. Ten Hag say na internal matter so him go deal with am internally.

But this one don make many people dey wonder say which kind internal issue go make player no even turn up on the day of match? Alan Shearer also recall sometime last season when the same Marcus Rashford chop punishment after him arrive late for meeting before one of them league matches.

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Alan Shearer

Na this one don make Shearer wey be Premier all-time top scorer de shake head with pity say Rashford just want to waste him talent. According to the legendary striker:

Marcus Rashford get big talent o, but the problem now be say him just want to waste am. Because we see the boy when him serious last season na. But this season so far, I no know wetin be him problem, whether him get family problem abi him girlfriend dey give am problem, or maybe na just village people, we need to help this boy and find out wetin be the problem otherwise him go just waste him career for nothing.

Alan Shearer also advice Rashford to find better manager and surround himself with wise people wey go dey remind am say if him continue like this and him career end, then him go truly regret him life and him wasted talent.

For now we dey wait to see how Erik Ten Hag wan take resolve Marcus Rashford internal problems.

Continue Reading

As e dey Go

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Published

on

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

As AFCON 2023 don enter knockout stage wey them don pair Nigeria to play Cameroon for the Round of 16 so, Super Eagles legend, Segun Odegbami don come outside like KingKong dey beat him chest say this Cameroon match go too easy for Nigeria because we go beat them like small pikin.

This one dey come after the AFCON wey dey happen inside Ivory Coast progress from the group stage enter knockout stages. This talk confuse many people because even for the group stage self, the Super Eagles no really impress as them manage to score only three goals in their three matches still finish second for the group.

On top of that the ball wey them dey play no even dey sweet for eyes make we say na that one we take hold body self. But on top of all of this, Mathematical Segun believe say Nigeria wey no dey give fans joy go easily beat and eliminate five-time AFCON champions, Cameroon from the competition.

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Segun Odegbami believe say Cameroon no be Nigeria mate

According to Odegbami:

Na this Cameroon wey everybody dey fear naim go be our easiest match for this AFCON. Because all those their gidigbo football wey them like to dey play no go work for this new stadium wey we dey go. The former stadium wey them been dey play rough like farmland. But na this smooth pitch naim we go catch them take show them correct pepper.

Segun Odegbami also talk say the Super Eagles dey improve for them game because after drawing their first match them win the last two. According to the legend, na progressive that so no shaking for that Round of 16 match.

Nigeria go play Cameroon for their Round of 16 match wey go happen on Saturday by 9pm Nigeria time. Wetin you think about that match? Abeg tell us for comment section.

Continue Reading

As e dey Go

No room for improvement for country wey don jabo from AFCON- Ghana fans

Published

on

No room for improvement for country wey don jabo from AFCON- Ghana fans

This 2023 African Cup of Nations (AFCON 2023) don dey tie wrapper. And after the Black Stars of Ghana squander 2-0 lead to finally draw Mozambique 2-2 take jabo from the competition, their fans don use provocation take dey attack them say them no try at all.

One fan wey them ask whether there is room for improvement for the team despite their poor showing, the fan tell them hoo-ha say no room for improvement for team wey them don eliminate.

Which kind room for improvement be that when we don eliminate from the competition? Na people wey qualify go dey find room for improvement, as far as Ghana is concerned, time for improvement don pass because the worst don already happen.

Na Jordan Ayew convert 2 penalties, one for each half to put Ghana up 2-0 and give them wetin oyibo dey call a seemingly unassailable lead. Na after 90 minutes naim unassailable lead become assailable when Geny Catamo convert Mozambique own penalty to make am 2-1 inside 91 minutes before Reinildo Mandava complete the comeback with 94th minute goal.

No room for improvement for country wey don jabo from AFCON- Ghana fans

Trezeguet and Mostafa help Egypt qualify

For the other match of the group, Mostafa Mohamed score 91st minute goal wey Egypt believe say them go take win 2-1 against Cape Verde only for Bryan Teixeira to score 99th minute equalizer for the Islanders to make am 2-2. But even the draw dey enough to qualify Egypt for the next round while Ghana carry their Ghana must go straight back to Kumasi.

Continue Reading

Trending