As e dey Hot

4 South African clubs don chop ban for life for 41 own goals in 2 matches

Published

on

This one na very worwor tory as we don dey hear now say 4 South African clubs don chop ban for life after the korokoro match fixing wey dem do wey make dem produce 41 own goals inside only 2 matches wey dem play against each other. The name of the clubs wey dey play for Division 4 inside Southie there na: Matiyasi FC, Shivulani Dangerous Tigers, Kotoko Happy Boys and Nsami Mighty Birds.

Apart from the 41 own goals, the South African clubs also score a total of 94 goals inside the 2 matches wey dem play. Na diswan make the league oga dem hala say, mbanunu, this water don pass garri, wey make dem quickly open register on top the 4 clubs head to begin investigate dem.

After investigation naim we find out say both Dangerous Tigers and Matiyasi FC dey drag who go top the league and gain automatic promotion into Division 3. Tigers use 3 points take dey top Matiyasi on top table so Matiyasi need to win dem last match well well to even get hope. Na so Matiyasi go arrange with Nsami Mighty Birds make dem open leg and collect wotorwotor. Na so Matiyasi take win with scoreline of 59-1.

Shivulani Dangerous Tigers (Image: Twitter)

But Matiyasi no know say when cunny man wan die anada cunny man dey on standby to bury am. When Dangerous Tigers wan play Happy Boys for dem final match, dem sef don run go arrange the tin so dat dem go keep Happy Boys happy and in return, Happy Boys go open leg for dem to collect wotorwotor. Na so Tigers take win dat match 33-1.

But the oga of the South African league dem begin ask whether na football those clubs play abi na basketball and when dem investigate finish, dem confirm say true-true na football dem play but the ojoro wey dey inside na generational ojoro wey South African football never witness before.

As a result, all the 4 clubs don chop life ban so dem can never operate as football club inside South Africa, whether na league o, non-league o, street football o, even monkey-post football, dem no fit organise to play again inside the country.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version